By: Esther Ayoola
Di Senate don explain dat, na wetin dem see for book, ni make dem take decide say electronic transmission of election results go dey optional instead of compulsory for di new Electoral Bill 2026.
Dem say di decision no be by emotion, but afta dem consult people for communication and power sectors about di real situation for di country.
Inside statement on Sunday, ni Senate Leader, Senator Opeyemi Bamidele, dey explain di whole mata, say lawmaking get serious responsibility and dem no fit make law wey go cause wahala for citizens.
Even though say Clause 60(3) bin tuk say results must dey transmitted to INEC IReV in real time, di Senate review am say if network fail, Form EC8A go serve as main way to collate results.