By: Esther Ayoola
Di Lagos State Waste Management Authority (LAWMA) don announce say dem go employ 300 pipo wey go dey make sure say Lagos streets dey clean.
LAWMA MD, Dr Olumuyiwa Gbadegesin, tuk dis one during a visit to one ogbonge news house for Lagos.
Gbadegesin sey, dem go sha train di people, den di LAWMA pipo, go con train Lagosians on how to handle waste, and anybodi wey no follow, go suffer am beta style.