By: Esther Ayoola
Ogun State Police command don plan to arrest one female TikTok user wey dem sabi as Mirabel afta investigation proof she lie say person rape her.
Nor be amebo say, Mirabel tuk for one viral phone chat with social media influencer, VeryDarkMan (VDM) of how one man rape her.
Say na only she implicate herself, tell VDM for audio call say, di claim na lie, For di audio wey VDM share online, she admit say some part of her first story nor correct.
She still tuk say na she create di threatening TikTok account herself to make her story sound real.