By: Esther Ayoola
Mexican soldiers don go kapi big-time drug lord Nemesio Ruben Oseguera Cervantes, wey dem dey call El Mencho, for di town of Tapalpa, Jalisco state, on Sunday,
According to Mexico Secretariat of National Defence, El Mencho, wey dey lead one of di most powerful crime gangs for Mexico, get $15m bounty from US gornment because of him criminal activities.
Say, di operation cause beta wahala for area, as gunmen burn cars and block roads for states like Jalisco, Colima, Michoacan, Nayarit, Guanajuato, and Tamaulipas, dat area scata for mexico.
Jalisco Govo, Pablo Lemus tell residents to stay house because of di gbege and suspend public transport, say nor be small tin for Mexico.