By: Esther Ayoola
Lagos Waste Management Authority (LAWMA) don begin serious clean-up along Lagos–Badagry Expressway.
For inside statement wey dem wrap like moimoi share to tori pipo on Monday, LAWMA Managing Director, Muyiwa Gbadegesin, say na heavy-duty carriers, loaders and support teams dem dey use take dey clear di illegal dump sites like Alaba Rago.
Oga Muyiwa, say di move na part of environmental sustainability and compliance drive wey go make corridor clean.
Im sha ginger residents, traders and transport operators to learn how to mange dia waste only through assigned Private Sector operators to help keep di road clean.