By: Esther Ayoola
US gornment don tell all non-important workers, make dem comot for embassy for Beirut, Lebanon, for security purpose.
Dis one dey hapun, as tension dey increase for di region, afta US Presido Donald Trump, say, im fit attack Iran if dem no agree on dia nuclear deal.
Iran say, if US attack, dem go fight back, and American bases for Middle East ni go be di target.
Meanwhile, Secretary of State Marco Rubio don delay him trip to Israel, but him never tuk why.