By: Esther Ayoola
Mexico don send plenty soldiers to control wahala for di kontri afta di death of one strong drug lord scarra everywia.
Defence Secretary Ricardo Trevilla tell tori pipo say, dem don carry 2,500 soldiers go west Mexico on Monday, and dat di total soldiers, wey dey now, na 9,500 since Sunday.
Plenti states, almost 20, don see nonsense, since Nemesio Oseguera Cervantes, wey dem sabi as “El Mencho”, die for Jalisco.
Nor be amebo say, di Jalisco New Generation Cartel (CJNG) na one of di most fearsome gang for Mexico, and El Mencho na di most wanted man, so dem dey try control di situation for Mexico.