By: Esther Ayoola
Four people don kpai afta one Iranian Army helicopter crash for fruit market on Tuesday morning for Khomeynishahr, Isfahan province.
According to state news agency IRNA, di pilot, co-pilot and two fruit sellers wey dey ground lose their life for di askident.
Dem say na technical problem cause di helicopter to fall enter di busy market area.
Dis crash na one of several air askidents wey don happen for Iran in recent years as officials tuk, say sanctions from obodo oyinbo sef dey make am hard to get spare parts for dia old aircraft.