By: Esther Ayoola
Report don land say, Japan wan position surface-to-air missile for one small island wey near Taiwan by March 2031.
Japan defence minister, Sanae Takaichi, explain, say Na di first time Japan dey share where dem go put missile for Yonaguni island since 2022.
While China dey claim Taiwan as dia own and report say, dem wan use force to “reunify” am.
Tension don dey rise like two days old soaked garri between Tokyo and Beijing since Japanese Prime Minister Sanae Takaichi say Japan fit use self-defence force if Taiwan come under attack.