By: Esther Ayoola
Say one jaguda boy enter area for Washington state, U.S. stab, stab pipo anyhow, and dat nobody sabi wetin im dey think cause dis serious damage to innocent pipo
Pierce County Sheriff say four pipo kpai for one house for di Tuesday attack.
Di Sheriff reveal dat, one police officer wey reach di scene at 9:33 ni shoot di 32-year-old suspect, and di man kpai on di spot.
Dem also report say one person wey suppose survive, dem rush am reach hospital, na so dat one sef die and dat di mata tire everybody.