By: Esther Ayoola
Naija First Lady, Oluremi Tinubu, don receive traditional title of Utukpa-Oritse (Ugbone) for Warri Kingdom as dem honour am for her public service and humanitarian work.
Di ceremony hapun for her maternal home, Warri, Delta State, where di monarch, Ogiame Atuwatse III, welcome am and praise her effort for women empowerment and social welfare.
For her speech, Mama Oluremi, say make Nigerians dey united and live as one, no mata di tribe, religion or political difference, say na one Naija go bring beta national development.