Iran launch fresh wave of missile and drone attack on Sunday, target 27 US military base for di region and Israel military headquarters for Tel Aviv, say na payback afta big US-Israel strike kill Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei.
Iran army for statement wey dem show for state TV talk say dia air force bomb US base for Gulf countries and Kurdistan region of Iraq for different phases of operation.
Iran state television konfamate say Khamenei, wey rule since 1989, die early Sunday, few hours afta US Presido, Donald Trump announce di killing of di 86-year-old cleric.
Iran Revolutionary Guards don vow say dem go launch ogbonge attack against Israel and US base, as tension for di Gulf still dey rise wetin no good.