Sports

Ronaldo Japa Go Madrid As Middle East Wahala blow Hot

todayMarch 3, 2026 4

Background
share close

Al-Nassr captain and forward, Cristiano Ronaldo,  comot Saudi Arabia go Madrid, Spain, as tension for Middle East dey rise after US and Israel launch strike for Iran.

According to reports on Tuesday, di 41-year-old football star fly comot Riyadh late for night inside im £61 million Bombardier Global Express 6500 private jet.

Di move happen after serious attack for di region, as two drones hit US embassy for Riyadh overnight.

Iran state media still say one command and staff building for Bahrain sef collect wetin nor good, as di crisis continue to grow.

 

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app