Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Federal Government don empower small-small farmers for Lagos State with farm inputs to help boost food production and improve food security for Nigeria.
Di empowerment programme wey Federal Ministry of Agriculture and Food Security carry out happen for Agege, Lagos on Thursday, and dem give 68 farmers cooperatives farm materials.
Agriculture Minister Abubakar Kyari, wey Dr Marcus Ogunbiyi represent, talk say di programme na part of Presido Bola Ahmed Tinubu Renewed Hope agenda to fight food shortage, reduce farming cost and increase harvest yield.
Dem distribute improved seeds, fertilisers, agrochemicals and other farm materials to help farmers increase production and improve their living conditions.
Im still talk say Lagos dey important for Nigeria agriculture value chain because of urban farming, fish farming, poultry and vegetable production wey dey grow for di state.
Written by: Ridwan Agbomeji
FG support farmers Lagos food security Nigeria Lagos State farmers
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026