Super Eagles captain, Wilfred Ndidi, say im and im teammates go still play di world cup play off if , FIFAÂ favour dem ahead of DR Congo.
Di super eagles miss automatic qualification, after losing 4–3 on penalties to DR Congo for African play-off final last November.
Nigeria Football Federation don carry matter go FIFA, tsay some DR Congo players switch nationality wrongly, so dem dey hope say, dem fit get second chance.
As e be now, FIFA never yarn anything, and na only 20 days remain to the play-off wey go happen for Mexico.