Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Wahala dem say nor dey finish, say nor be small fight burst for Brazil during Campeonato Mineiro final between Cruzeiro and Atlético Mineiro after Cruzeiro manage win di match 1–0.
Di trouble start for deep stoppage time when Atlético goalkeeper Everson rugby-tackle Cruzeiro midfielder Christian after dem clash as di keeper drop di ball.
Everson even kneel for Christian face and shout for am, and na dat one make Cruzeiro players vex rush am, push am enter net and den big fight start.
Afta di match, referee check everything again come give 23 red cards , 12 to Cruzeiro players and 11 to Atlético players, as punches, kicks and pushing scara di pitch.
Written by: News Author
Association football Brazil football controversy Brazilian football league system referee red card record
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026