Sports

Moffi Score, Sanusi Give Assist As FC Porto Beat Stuttgart 2-1

todayMarch 13, 2026

Background
share close

By: Esther Ayoola

Terem Moffi score one goal and Zaidu Sanusi give assist as FC Porto beat Stuttgart 2-1 away for dia UEFA Europa League Round of 16 first leg game for Germany on Thursday.

Moffi start di game but comot for 59th minute, while Sanusi play full 90 minutes.

Moffi open scoring for di 21st minute, and later Sanusi set up Rodrigo Mora to make am 2-0.

Stuttgart reduce di score with five minutes left for first half, na Deniz Undav score dia only goal.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app