By: Esther Ayoola
Popular comedian and skit maker, Samuel Perry, AKA, Broda Shaggy, say im don land hospital afta dem reportedly shoot am for Sango-Ota, Ogun State.
According to report, di thing hapun under Sango-Ota bridge.
Police source wey tell tori pipo say, Broda Shaggy suffer di gunshot while e dey film comedy skit for di area.
Dem rush am go Hospital for Alakuko, Lagos, an dat e dey receive treatment now.