Nigeria Senior team, di Tigress don finish dia pre world cup matches with a lose, 93–86 to France for di FIBA Women’s Basketball World Cup Qualifying Tournament wey hapun for Villeurbanne on Sunday.
French women, wey dey number three for world, start strong for first quarter and take di early lead.
Nigeria tigress show character fight back for second half, even reduce di gap to just two points.
However sha, dem no fit catch up as France maintain their unbeaten run for di tournament.