By: Esther Ayoola
Sébastien Desabre, coach of DR Congo national football team, say like dis im boys don dey jim bodi for dia 2026 FIFA World Cup intercontinental play-off.
Say Dem go travel to Mexico, play for Guadalajara and Monterrey, join other five countries wey dey fight for di last two spots.
DR Congo, wey beat Naija 4–3 on penalties for African play-off final, go face di winner between Jamaica and New Caledonia.
Desabre hope be say im fit carry di Leopards go World Cup for di first time since 1974.