Sports

D’Tigress Lose Last Game To Germany 81–73 For FIBA Qualifiers

todayMarch 18, 2026 2

Background
share close

Nigeria women basketball team, D’Tigress, don end dia campaign for 2026 FIBA Women’s World Cup Qualifying Tournament with 73–81 loss to Germany for Villeurbanne, France.

Germany control di game from start to finish, lead for every quarter and take charge for more than 33 minutes before dem pull clear for last quarter.

Nigeria try fight back for second quarter, turn six-point deficit to 31–27 lead with one 10-0 run, as Elizabeth Balogun help with key points.

But Germany quickly bounce back with dia own 10-0 run, carry di momentum go third quarter and secure di win.

 

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app