Sports

Lookman Assist Make Atlético Madrid Beat Spurs 7-5 For UCL

todayMarch 19, 2026 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Ademola Lookman give assist as Atlético Madrid qualify for UEFA Champions League quater finals, even though dem lose 3-2 to Tottenham Hotspur for di second leg.

Lookman collect ball for counter, cut small for box corner, then pass am to Julian Alvarez wey score make e 1-1.

Tottenham first goal na from Randal Kolo Muani, then Xavi Simons score two, one na penalty.

Atlético second goal come from David Hancko wey head in from corner, so Atlético carry 7-5 aggregate go next round.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app