By: Esther Ayoola
US intelligence don shake table say Iran nor even rebuild dia nuclear machine wey US and Israel destroy last June 2025.
Trump ally and US national intelligence director, Tulsi Gabbard, na tuk dis one for her written testimony to Senate intelligence committee on Wednesday for Washington, DC.
She explain say afta Operation Midnight Hammer, Iran nuclear plan end and dat Iran nor do any rebuild, reason wey President Trump take dey bomb Iran.
U sabi say, Trump dey always tuk say na because of imminent threat dey, ni make am order di attack with Israel on February 28, well right now confusion gadima.