By: Esther Ayoola
Police oga for Naija, Olatunji Disu, on Sunday for Abuja don order make dem reduce tactical teams across di country.
According to police tuk tuk, Anthony Placid, say di IGP say zonal and state commands no go get pass five teams, while area commands and divisions go get only three teams.
Im explain say dis decision come based on di plenty tactical units wahala and dat some dey misbehave without better supervision, dey oppress members of di public.
Oga Placid, say, moving foward Dem go do merging or disbanding some teams, so officers go fit dey on ground to tackle other security matas.