INEC do Drama for inside
Federal High Court Abuja on Tuesday, November 17, 2026, as lawyers for Independent National Electoral Commission (INEC) complain say
Omoyele Sowore and him supporters dey harass dem.
Dis gbege happen during Sowore cyberbullying trial, where INEC lawyer ask judge make e cancel court order wey force INEC Chairman, Prof. Joash Amupitan, to bring President Bola Tinubu old election papers.
Even though di court matter stop halfway because di judge body no well, tension still catch fire outside court astori pipo accuse im boys say dem spoil one reporter motor.
INEC lawyers beg court make e protect dem, because di way im pipo dey chase dem up and down, court premises don turn wrestling ring where everybody dey run for dia life!