Naija Education Minister, Dr Tunji Alausa, like dis na, dey look for serious business pipo to hellep fix education through di Nigeria Education Sector Renewal Initiative (NESRI).
Oga Education minister yan dis one for roundtable breakfast tuk tuk wey im do with stakeholders and top business pipo for Lagos.
Alausa say, di new move go bring beta management to wi schools, and e go hellep Naija schools compete with resof di world.
Alausa add say dem go increase Technical and Vocational schools, plus make Science, Technology, Engineering and Maths (STEM) strong.