obodo oyinbo

Pope Leo XIV Explain Why God No Go Hear Di Prayers Of Those Wey Dey Cause War

todayMarch 30, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

Pope Leo XIV don cut chain oh, say, God nor go hear di prayers of pipo wey dey cause war, problem left, right and centre.

Di Pop yarn dis one after di Angelus prayer, E pray for Christians for Middle East wey dey suffer because of the fight and no fit celebrate dia holy days.

Earlier this week, im ask make all sides stop di war and begin tuk, as more than one million pipo dey homeless because of di war.

Di American pope don always condemn the war and dey call for peace tuk.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app