By: Esther Ayoola
North Melbourne player Tristan Xerri don collect three-match ban afta e use im nose blood rub Andy McGrath face for match wey dem play on Saturday.
Di incident hapun afta Xerri score goal, come get small fight with McGrath before e wipe di blood, something wey officials call “disgraceful behaviour.”
For tribunal, Xerri tuk say dem insult am call am “weak c-word,” naim make e lose im temper do wetin e do.
But e sti accept say na im fault, as e “completely own” di mistake and agree with di charge.