By: Esther Ayoola
Russia don order British diplomat Albertus Gerhardus Janse Van Rensburg to leave Moscow afta dem accuse am say e dey do spy work
According to FSB security service report on Monday, di 29-year-old embassy secretary dey accused of “subversive intelligence activities wey fit threaten Russia security,”.
Russian foreign ministry tuk say dem don call Britain charge d’affaires come warn dem wella dat if dem do dem wetin UK do, dem nor go like am.
Britain embassy never say anything publicly so far, and dem give di diplomat two weeks to leave Russia.