By: Esther Ayoola
Say like dis now, Plenty fans wey dey support Premier League clubs dey complain say VAR don spoil dia matchday enjoyment.
Dis na according to one survey wey Football Supporters’ Association (FSA) do on Monday across England.
Di survey, wey collect response from almost 8,000 fans from all 20 Premier League clubs, show say over 90% of dem believe VAR don make stadium experience worse.
Say about 91% of fans tuk say VAR don kill di joy and quick celebration wey dey hapun when goal enter, while 94% no gree say e affect watching match for TV.