By: Esther Ayoola
Quadri Aruna dey face wahala for di ITTF World Cup as e lose 3-0 to Tomislav Pucar for him first Group 6 match for Macao on Monday.
Pucar carry di win with scores 11-4, 12-10, 11-6 for dia first ever match.
Like dis now, Aruna, wey be di only African wey don reach World Cup quarterfinal before, gats beat Sora Matsushima for him next match if e wan continue for di tournament.
Say na Only di group winner go enter di knockout stage, so di Naija player need sharp comeback to avoid early comot.