Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Wi oga Presido, Bola Tinubu don tell security mehn make dem hunt down di jaguda boys wey dey behind di killings for Plateau State and Kaduna State.
Nor be amebo say Gunmen kpai about 28 pipo for Angwan Rukuba, Jos, and some others attack Kahir village for Kaduna, kill plenty pipo.
Tinubu say di kpaing and wedding abduction na shame for Naija and make security agencies dey pursue di criminals plus people wey dey spread fake news.
E also urge communities make dem follow evacuation and relocation advice to protect lives and property.
Written by: News Author
Kaduna attack Plateau attack Tinubu directive Tinubu security order
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026