By: Esther Ayoola
World Bank don share update, say poverty dey press Naija for neck, dat e don rise enter 63% for 2025, not minding say inflation slow down small.
Dem show for dia Naija Development Update say, poverty move from 56% for 2023, enter 61% for 2024, then reach 63% for 2025.
Dis one mean say economic stabilizing nor be for di poor for Nigerians.
In all, about 140 million Nigerians sti dey live under poverty line.