By: Esther Ayoola
Germany don open application for one scholarship programme wey dey target graduates and postgraduates from Sub-Saharan Africa, to give dem chance for further study and research abroad.
Dem announce am for dia X handle on Friday, tuk say na part of their plan to support international academic cooperation.
Dem say DAAD scholarship don ready now and make interested people check di flier for full details and apply before deadline wey be 29 April 2026.
Dem sti advise applicants make dem follow all instructions for di official flier well well, as e get information about who fit apply, schools wey dey involved, and how to submit application.