By: Esther Ayoola
Di Lagos State Police Command on Sunday for dia official X handle @LagosPoliceNG don clear mata say dem don start investigation into di shooting wey kpai one-man wey dem dey call “Agali” for Surulere.
According to report dis incident hapun on Saturday night around for National Stadium Bridge, Surulere.
Video wey go viral on X show di damaged white car and crowd, and dem claim say e fit be cult wahala and local tension, but police say those claims never hold water.
Police sti konfam say di victim wey dem rush go Mainland General Hospital, Yaba, later kpai for hospital, but dem sti dey investigate di mata.