National

FG Remove Import Duty For Buses, EVS, Machine To Ease Economy Wahala

todayApril 13, 2026 2

Background
share close

Federal Gornment don grant waiver wey go remove import duty for mass transit buses, electric vehicles, and manufacturing machines.

Dis move come as President Bola Ahmed Tinubu direct economic team make dem find way reduce pressure wey high fuel price and global crisis dey put on Nigerians.

According to statement wey Presidential aide Dada Olusegun post for X, di policy na to hellep reduce inflation and make life and business cheaper.

Gornment say dem sti dey plan more tax cuts to support pipo and businesses for country.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app