For Ghana, say Premier League footballer Dominic Frimpong kpai afta armed robbers attackĀ dia team bus on Sunday night as di team dey come back from away match for Ashanti Region.
Di club Berekum Chelsea FC naim konfamate dis mata, say masked men wey carry guns and assault rifle open fire for di team bus, na so players scata.
Ghana Police Service tuk say di incident hapun around 10:30pm for Ahyiresu-Kwame Dwumor Sreso road for Nyinahin District, and dem rush Frimpong go hospital afta he collect bullet wound.
Police add say di reason for di attack , say naĀ armed robbers attack di team, and even though di player reachĀ hospital, Frimpong sti kpai because of di wunjuries.