Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Sporting Lagos don secure dia return to Nigeria Premier Football League (NPFL) after dem beat Osun United 1-0 for Ileogbo, Osun State.
Na Alex Leme score di only goal, while goalkeeper Clinton Lawal make serious key saves wey help dem hold di win.
Dem finish top for NNL Conference B with 36 points, just one point ahead of Akwa United wey get 35 points.
Na dat win make sure say Sporting Lagos nor allow Akwa United carry di promotion ticket for last day.
Written by: Ridwan Agbomeji
late win Sporting Lagos NPFL playoff Sporting Lagos Osun United vs Sporting Lagos Sporting Lagos 1-0 Osun United Sporting Lagos back to NPFL Sporting Lagos NPFL promotion Sporting Lagos promotion win
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026