Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Oga Commissioner of Police for Lagos State Command, Fatai Tijani, don dey ginger boys wey apply for di 2025/2026 Police Constable Recruitment Screening, to sharpaly finish dia screening before Saturday deadline.
E yarn dis one on Thursday as e visit screening centre for Police College, Ikeja, where e go check how di exercise dey go and ensure say everything dey follow di rules.
Say, di Commissioner also meet officials from Police Service Commission, Federal Character Commission, and Police Community Relations Committee wey dey monitor di exercise to make sure say e fair and transparent.
Written by: Ridwan Agbomeji
Fatai Tijani urge applicants Lagos CP Fatai News Lagos police News update Lagos Security police recruitment
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026