Ogun Police Command don call for beta join-body work wit NDLEA to tackle drug abuse and trafficking for di state.
Police tuk, tuk person, DSP Oluseyi Babaseyi, naim dey konfamate dis mata, say Commissioner of Police, CP Bode Ojajuni, don even visit NDLEA office for Abeokuta for di collabo mata sef.
Say dem agree to dey share intelligence, do joint operations, and also carry public awareness go communities.
NDLEA also honour CP Ojajuni wit War Against Drug Abuse (WADA) ambassador title for di support wey im show, say im try.