south west

105 Results / Page 1 of 12

Background

south west

Police Rescue Kidnap Victim, Recover Two AK-47 Rifles

By: Kofoworola Olayinka Ogun Police don rescue one professional truck driver wey kidnappers abduct for Ibese on August 25. Di Anti-Kidnapping Unit carry out di operation after dem receive report, leading to di victim’s rescue and recovery of two AK-47 rifles. Police also recover 25 rounds of ammunition, two phones and N2 million cash wey dem suspect say na crime money.

todayAugust 31, 2026 4

south west

Female Visitor Arrested Over Suspected Drug Smuggling

By: Kofoworola Olayinka Correctional officers don arrest Mrs Iyabo Sowunmi for allegedly trying to smuggle suspected Colos drug into Ibara prison for Abeokuta. Dem arrest her around 1:33pm on Friday during routine screening after officers find suspicious substance hidden inside one-kilogramme Milo sachet. Ogun Correctional Service spokesperson Odukoya Olayinka confirm di arrest on Monday, saying di substance dey suspected to be Colos

todayAugust 31, 2026 4

south west

Ogun Police Burst Alleged Baby Factory, Rescue Six

By: Yusuf Abuh Ogun Police don burst alleged baby factory for Mowe on Monday, August 24, rescuing two pregnant women and four children. Police spokesperson DSP Oluseyi Babaseyi disclose di operation on Tuesday, say six suspects dey custody over alleged human trafficking and illegal adoption. Operatives carry out di raid around 8am for Toluwalase Street, Abaren Village, after sustained intelligence on activities inside di facility. Police say dem dey continue […]

todayAugust 25, 2026 9

south west

Adeleke Collobi Second Term, Beat APC Candidate Oyebamiji by 66,252 Votes

By Ebi Oboko Gofnor Ademola Adeleke don win Osun State gofnorship election again after e collect 511,067 votes for Saturday election. Di Returning Officer, Professor Joshua Ogunwole, announce di result for INEC Collation Centre for Osogbo early Sunday morning. Adeleke, wey contest under Accord Party, beat im closest challenger, APC candidate Bola Oyebamiji, wey get 444,815 votes. With di result, Adeleke get winning margin of 66,252 votes ahead of Oyebamiji. […]

todayAugust 16, 2026 64 11

south west

FRSC Send 2,500 Worker For Osun Election

By: Kofoworola Olayinka FRSC don send 2,500 worker and 50 vehicle to manage traffic for Osun gorfnorship election on Saturday. Di sending cover all three senate districts and operational areas across di state. FRSC say dem include seven tow truck and six ambulance for emergency response. Di agency say di move na to ensure smooth traffic, quick response and obey with movement restriction during di election.

todayAugust 14, 2026 12 1

south west

Customs Seize N3.57bn Smuggled Goods For Ogun

By: Kofoworola Olayinka Nigeria Custom don seize cannabis, foreign rice and other ban goods wey worth N3.57 billion for Ogun State. Acting Area Controller Oladapo Afeni announce di item wey dem seize on Thursday for Idiroko. Di item include 6,035 parcel of cannabis, 2,339 bag of foreign rice and over 13,000 litre of petroleum product. Custom say dem seize di goods between June 24 and August 13 as part of […]

todayAugust 14, 2026 17 1

south west

LAUTECH Doctors Threaten Fresh Strike From August 28

By: Kofoworola Olayinka Resident doctors for LAUTECH Teaching Hospital, Ogbomoso, don threaten to resume strike on August 28 if dem demand no dey settled. Di doctor issue di warning on Thursday through statement wey dia leader, Dr. Adedapo Mustapha and Dr. John Stephen, sign. Dem suspend di strike on June 27 and give management eight weeks to address dia welfare concern. Di association say dem suspend di action in good […]

todayAugust 13, 2026 17

south west

Ondo AG Warns Obas: Palaces No Be Court Or Prison

By: Kofoworola Olayinka Ondo Attorney-General, Olukayode Ajulo, don warn traditional rulers make dem no turn palaces into courts or detention centres. Ajulo give di warning on Wednesday for Akure during workshop for traditional rulers, say dem must operate within di law. Im say Obas suppose settle disputes through mediation and refer criminal matters to police and other authorised agencies. Ajulo also urge traditional rulers to provide useful community information to […]

todayAugust 13, 2026 13

south west

Osun Senator Fadahunsi Clear Im Name After Viral Kill Video

By: Yusuf Abuh Senator representing Osun East, Francis Fadahunsi, don clear im name after one viral video wey suggest say e tell im supporters to kpai Accord Party members and dia families, say nor be wetin im mean dem edit. Fadahunsi tok dis one on Wednesday after police question am for Osun State Police Command headquarters for Osogbo over di controversial video. Di senator explain say when e use di […]

todayAugust 13, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds