Monarchs from Ilaje Local Government Area for Ondo State don wire appeal letter wi oga Presido, Bola Tinubu make dem dis pipeline surveillance work touch everywia.
Di traditional rulers under Ilaje Council of Obas tuk dis one inside letter wey dem send to President and sign by Secretary, Oba Obafemi Ogbaro, after dem meet for Igbokoda headquarters on Friday.
Dem explain say di current central system dey limit community involvement and e dey create security gap wey fit affect oil assets and peace for coastal areas.
Dem beg federal gornment make dem involve local communities more so dat, dem fit help reduce vandalism and protect national resources better.