By: Esther Ayoola
US Presido and Im Navy don go intercept one Iranian cargo ship wey dem dey call Touska for Gulf, as part of dia blockade dey cause serious gbege.
Trump explain for im Truth Social say di ship no respond when dem warn am make e stop, naim make dem seize am.
Iran dey vex for di other side, say na violation of ceasefire and dem go retaliate, calling am “armed piracy.”
Meanwhile, US Vice-President JD Vance dey lead another delegation go Pakistan for tuk to end di war, but Iran sti never konfam if dem go join because of di blockade.