By: Esther Ayoola
Teachers wey dey work for gornment schools inside FCT don start one indefinite strike say Federal Gornment suppose do settlement for dem.
When tori pipo waka go some schools for Area 10 Garki and Gornment Science Technical College for Area 3, dem see say everywhere dey empty, no students or teachers dey around.
Dis strike come afta Naija Union of Teachers (NUT) for FCT talk say make all primary and secondary school teachers stop work from Monday.
Union leaders say dem dey take dis decision because gornment keep quiet afta dem give ultimatum, and as hardship sti dey increase, teachers no fit continue like dis again.