Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Say one serious road askident wey hapun for Motorways Inward Estate area for Alapere, Lagos State, don kpai one dispatch rider.
According to Lagos State Traffic Management oga, Adebayo Taofiq, di askident involve empty NIPCO Tanker and di rider.
Taofiq say di tanker driver bin dey speed when e jam di moving dispatch rider, and di rider kpai on di spot.
LASTMA officials quickly rush go di scene to control di wahala as other dispatch riders vex bin wan attack di tanker driver.
Written by: News Author
Alapere accident Dispatch rider killed Ketu accident news Lagos Road Accident Speeding tanker accident Tanker crash Lagos
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026