Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Senate don direct Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede, and other service chiefs make dem carry out full operational and logistical audit afta Boko Haram attack military formations for Benisheikh and Monguno, Borno State.
Borno North Senator, Tahir Monguno, joining force with orda lawmakers naim raise di motion for di senate on Wednesday, for Abuja.
Di Lawmakers order say dem must review how di attack hapun, check equipment level, and ensure, di soldiers follow correct rules of engagement.
Senate also ask military make dem investigate any allegation of civilian casualties to ensure accountability and prevent future incidents.
Written by: News Author
Boko Haram attacks Borno attack military base attack Borno military investigation Nigeria Nigerian Senate directive Senate Nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026