OBODO NAIJA

Soldiers Push Back Attack for Yobe, Kpai 24 Jaguda Boys

todayApril 23, 2026 4

Background
share close

Operation Hadin Kai Troops don fire back as jaguda boys try attack dem for midnight for military base inside Kukareta, Yobe State, as dem kpai 24 of di jaguda boys.

Di gbege start early Thursday and e last for about three hours before soldiers overpower di jaguda boys.

Media Information Officer for Joint Task Force, North-East Operation Hadin Kai, Lt. Col. Sani Uba, na im confirm di matter say di attack start small time after midnight and soldiers respond sharp-sharp with correct counter fire.

According to am, di troops hold ground, contain di attack, and force di jaguda run comot anyhow with confusion as soldiers chase dem.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app