Sports

FIFA Plan New Yellow Card Rule

todayApril 28, 2026 5

Background
share close

Say like dis FIFA, dey consider new disciplinary rule ahead of expanded FIFA World Cup.

Di proposal be say dem wan add second “amnesty point” wey go wipe yellow cards after group stage and again after quarter-finals, dis one mean say, suspension go reduce.

According to report, Dem dey do am because with 48 teams, players fit play up to six matches before semi-finals, and under current rule two yellow cards na suspension.

Di aim for di World Cup na to stop key players from missing big knockout matches because of small small fouls

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds