Omo nor be small jolitainment for New York City, say big names for dia fashion, music and film celebrate shege comot for dis year Met Gala.
Met gala na yearly fashion show wey dem show case different design
Say dis year own dem title am, Costume Art, putting spotlight on fashion as art, as celebrities team up with top designers show bold, eye-catching outfits for red carpet.
Explaining di event, according to di Organiser, Anna Wintour, say normally na every first Monday of May dem dey celebrate di Met Gala to raise millions and promote fashion as serious art, with invite-only guests wey dey draw global media attention.