World Health Organization don talk on Thursday say more hantavirus cases fit still show up, but if people follow safety rules, di outbreak go likely stay limited.
Di warning come after di virus kpai three passengers from cruise ship MV Hondius, as another sick passenger land for Europe earlier that day for treatment.
Di ship dey head go one Spanish island as health officials dey rush trace di outbreak of di rare hantavirus strain wey fit spread between humans under close contact.
WHO oga , Tedros Adhanom Ghebreyesus, tell tori pipo for Geneva say five confirmed cases and three suspected cases don show so far, including di three wey kpai.